28 Wen Saul know sey God dey with David and en pikin Mikal love David well-well,
Dem ansa, “E klear sey God dey with yu. So wi kon sey, make peace dey between us: dat is between wi and yu. Make yu allow us make peace with yu,
But Laban sey, “If really sey I dey good to yu, den yu go stay with mi, bikos my spirit tell mi sey, God bless mi, bikos of yu.”
En oga kon si sey God dey with am and God dey make evritin wey Josef do, betta.
Listin! Doz pipol from Satan sinagog wey lie sey dem bi Jew, I go make dem bow for yor front, den dem go know sey I really love yu.
Mikal wey bi Saul pikin, like David. Wen dem tell Saul wetin dey happen, en belle kon sweet am.
den David with en men go fight kon kill two hundred Filistia pipol. David take dia skin go give Saul, so dat e go fit marry di king pikin. So Saul give en pikin Mikal to David make e marry.
e kon dey fear David more-more and from dat day go, Saul kon hate David more-more.
Si naw, I don know sey na yu really go bi king and yu go build Israel kingdom with yor hand.
So Saul ansa David, “My pikin! Make God bless yu. Yu go dey prosper for evritin wey yu do.” So David go en own way and Saul kon go back.