As dem bring di box kom di town, Mikal wey bi Saul girl pikin look from window and e si David as e dey dance well-well with only linen klot, di woman kon dey shame, bikos of David, en husband.
Afta, wen David go greet en family for house, Mikal kom meet and tell David for outside sey, “Israel king don fool ensef well-well today! E disgrace ensef for en girls savant and ofisas front!”