15 Wen Saul si as David wise rish, e kon dey fear am.
Pipol wey dey dash oda pipol money, dey do dia business well and na dem good tins dey follow.
Make una dey wise as una dey tok with pipol wey nor dey follow Christ. Make una use evry shance wey una get well.
But if anybody nid wisdom, make e ask God wey dey gi-am to evribody. E nor go sey, “No,” but E go give yu.
But God wisdom dey pure; e get peace; dey gentol; dey asept pipol and good fruit and mesi full am; e nor dey do wayo or pritend.
So Saul kon dey fear David, bikos God Spirit wey don komot from am, dey with David.
David dey use sense take do evritin wey Saul send am, bikos God dey with am.
But evribody for Israel and Judah like David, bikos na en dey take dem go war and bring dem back.