Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Samuel 18:14 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

14 David dey use sense take do evritin wey Saul send am, bikos God dey with am.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Samuel 18:14
18 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Di pesin wey dey guide di prison nor kare about anytin wey dem sey make Josef do or look afta, bikos God dey with Josef. Anytin wey e do, God dey make am susid.


David kon dey strong evriday, bikos Oga God wey dey mighty, dey with am.


God dey with am, so evritin wey e dey do, dey prosper. E fight against Assyria pipol and e nor fear dem.


E put guards for Edom. Na King David dey rule all di pipol for der and God make David win all en war.


Den David set soja kamp for dia aria kon dey rule and kollect tax from dem. God give David viktory for evriwhere.


God bin dey with Jehoshafat wen e start to rule, bikos e dey obey God like David en grand-grand papa. E nor gri serve juju,


Make Yu help mi to do di rite tin, so dat I go dey honest and dey do good as I dey rule my kingdom.


“Si! Di woman wey neva sleep with man before go get belle and e go born boy and dem go koll am, ‘Emmanuel’ wey mean, ‘God dey with us.’ ”


dey tish dem to do evritin wey I tish una. I go always dey with una until di world go end.”


I dey for yor side and nobody go fit do yu anytin, bikos I get plenty pipol for dis town.”


God dey with Joshua and pipol kon know am for evriwhere.


God dey with Judah pipol, so dem take di hill kountry. But dem nor fit drive di pipol wey dey di koast aria komot, bikos di pipol shariot, bi like iron.


Wen dis signs don happen, make yu do anytin wey yu fit do, bikos God go dey with yu.


One of en savant kon sey, “I don si one of Jesse pikin wey dey Betlehem wey know how to play di jita. E dey strong and e get mind; e know book and e fine well-well, bikos God dey with am.”


Wen Saul si as David wise rish, e kon dey fear am.


War kon start again. So David kon go fight Filistia pipol. E win dem well-well and di remainin ones, run from am.


Samuel kon dey grow and God dey with am. Anytin wey e tok, must happen.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ