56 Di king kon sey, “Make yu go find out wish pesin pikin e bi?”
But Saul ansa David, “Yu nor go fit fight dis Filistia man, bikos e don tey wen dis man don dey fight and yu still small!”
As Saul dey wosh David dey go fight di Filistia man, e kon ask Abner wey bi di sojas oga sey, “Abner! Na wish pesin pikin bi dis sef?” Abner ansa, “My king, I nor know.”
So wen David kom back afta e don kill di Filistia man, Abner kon take am go meet Saul. David still hold Goliat head for en hand.