Moses kon tell Aaron, “Make yu measure one omer for manna with one kontaina, den put am for where Oga God Spirit dey, so dat E go take am dey remember di generashon wey dey kom for back.”
As Saul dey wosh David dey go fight di Filistia man, e kon ask Abner wey bi di sojas oga sey, “Abner! Na wish pesin pikin bi dis sef?” Abner ansa, “My king, I nor know.”
Di priest ansa, “Goliat, Filistia pipol wey yu kill for Ela Valley, na only en swod wey dem wrap with klot put for di efod back, dey here. If yu wont am, make only yu go take am. Anytin wey pass dat one, nor dey here.” David kon sey, “Nor-tin good rish dat one! Make yu give mi!”