48 Goliat kon waka dey kom meet David, so dat e go attack am, den David kwik-kwik run go front go attack Goliat.
Na God bi my lite and my salvashon, so na who I go kon dey fear? Na en dey guide and protet mi from danger, so wetin go make mi dey shake?
Even doh strong sojas gada round mi, my heart nor go fear. Even if dem attack mi, I don go shek at-all.
Wiked pesin dey run wen nobody dey porshu am, but honest pesin dey get heart like lion.
David put en hand inside di bag kon take one stone. E put am for di katapault kon shot di Filistia man for en head. Di stone enter en fore head well-well and e kon fall face groun.