Den Naaman and all en men go back go meet and stand for di profet front kon sey, “True-true, I don know naw sey e nor get any God for dis eart escept Israel own! Abeg make yu take dis gift from yor savant.”
King Asa pray to di Oga wey bi en God sey, “My Oga God! Na Yu dey make weak pipol strong. Wi dey go fight dis many sojas, bikos wi bilive sey Yu go help us.”
En royal pawa go kontinue to grow. En kingdom go get peace forever. E go rule well like King David kon do betta tins with en pawa; e nor go opress pipol and E go rule from naw go rish wen di world go end. God Almighty go do all dis tins.
But I go love and sorry for Judah pipol. Mi wey bi dia Oga God, go save dem, but e nor go bi thru war, swod, bow, arrow, horse or doz wey dey ride di horse dem.”
Jonatan kon tell en savant, “Kom make wi go di oda side go meet all dis men wey dem nor sekonsaiz. May bi God fit fight for us. Nor-tin go fit stop God to save us, weda dem many or small.”
Den Saul tell David, “Na my senior girl bi dis, en name na Merab. I wont make yu marry am. I just wont make yu dey strong for mi and fight God war.” Bikos Saul tink sey, “No nid for mi to kill-am, make Filistia pipol kill-am!”