41 Di Filistia man with di pesin wey karry en swod kon dey waka kom meet David.
God kon tell Joshua, “Dis swod wey dey yor hand, make yu point am face Ai, bikos I don gi-am to yu and yor sojas.”
David karry en stik for en hand kon pick five good stone from di stream, den e put dem for en animal bag. E take en katapault kon dey go meet di Filistia man.
Wen di Filistia man near David, e kon vex well-well, bikos na small and fine boy e bi.
En spear mout tick well-well and di iron heavy rish fifteen pounds. Di pesin wey dey karry en shield, dey waka for en front.