18 Den give dia oga dis biscuits. Make yu find out how yor brodas dey, den kom back kon tell mi weda dem get evritin wey I dey send yu go give dem.
Israel kon tell Josef, “Yor brodas dey for di field near Shekem. Make yu kom make I send yu go meet dem.” Josef ansa, “Papa! I don ready.”
So Jakob tell am, “Make yu go si as yor brodas and di animals dey, den kon tell mi weda dem dey okay.” So Jakob send am go from Hebron Valley.
Dem know sey David and en men go dey hongry and wota don dey hongry dem since for di wildaness.
Evriday, Mordekai dey go meet Estha, so dat e go know how tins bi with am.
Na yor pawa my papa take born mi; na Yu make mi grow for my mama belle.
So Moses go meet en wife papa, bow kon kiss am. Dem greet each oda kon enter house.
Afta some days, Paul kon tell Banabas, “Make wi go back go visit di brodas for all di town wey wi for prish God word, so dat wi go know how dem dey.”
So dem enter Mikah house where di yong priest dey stay kon greet am well.
So Jesse load one donkey with bread, one kontaina wey get wine and one goat kon send dem with en pikin David, go meet Saul.
Dem dey with Saul and Israel men wey won fight Filistia pipol for Ela Valley.”
e send ten savant kon tell dem, “Make una go meet Nabal for Karmel kon tell am sey I dey greet am.
Naw, David don near di two hundred men wey don taya well-well to follow am go; doz wey dem live for River Besor. Dem kon go meet David and di pipol wey dey with am. Wen David rish where di two hundred men dey, e kon ask dem, “How una body!”