But Jonadab wey bi David broda, Shimei pikin kon sey, “My king, dem neva kill all yor shidren, na only Amnon dem kill. Yu suppose know sey Absalom go kill-am, since di time wen e force and sleep with en sista Tamar.
Wen en senior broda Eliab hear am dey tok to di men, e kon vex tell David, “Wetin make yu kom der? Na who yu sey make e guide doz sheep for di desert? I know sey yu like to show yorsef! Yu just kom here to wosh di fight!”