Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Samuel 17:10 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

10 Den e kon sey, “I dey shalenge Israel sojas today sey, ‘Make una pick one pesin, make e kon fight mi!’ ”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Samuel 17:10
14 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

E trobol Israel pipol well-well, so Jonatan wey bi David broda Shimei pikin kon kill-am.


Di sekond one for Di Three wey get pawa, na Eleazar wey bi Dodo pikin from Ahohi family. One day, en and David shalenge Filistia pipol wey gada for war, even wen Israel pipol run go back,


May bi di Oga yor God go hear all di tins wey di shief adviser sey Assyria king sey make e tok against God wey dey alive. Wen di Oga yor God hear, may bi E go ponish Assyria king for all di tins wey e tok. So make yu pray to God for awa pipol wey remain.’ ”


Wen Sanballat, Tobaya and one Arab man wey en name bi Geshem, hear wetin wi dey plan to do, dem kon dey laf us sey, “Wetin una tink sey una dey do so? Una won fight against di king?”


Pride dey bring distroshon and sturbones fit kill pesin.


God sey, “Make wise pipol nor dey boast, bikos dem wise and make doz wey strong, nor boast sey dem get pawa. Make doz wey get money, nor boast with di money wey dem get.


Naw, mi Nebukadnezzar praiz, woship and hail di King wey dey heaven. Evritin wey E dey do dey rite and en ways dey pure. Pipol wey dey karry body up, E dey bring dem down.


Wen Saul and Israel pipol hear wetin di Filistia man tok, dem vex well-well and fear kon dey katch dem.


Yor savant don kill both lion and bear. Dis Filistia man wey dem nor sekonsaiz go bi like one of dem. Bikos e don shalenge God wey dey alive sojas!”


But David ansa am, “Yu dey kom meet mi with swod, spear and javelin. But I dey kom meet yu with di name of di Oga wey bi God of all ogas; Israel sojas God wey yu dey shalenge.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ