Make awa oga tell wi yor savant make wi look for anybody wey sabi play jita. Den wen ever di wiked spirit kom from God kon enter yu, e go play di jita and yu go kon dey okay.”
One of en savant kon sey, “I don si one of Jesse pikin wey dey Betlehem wey know how to play di jita. E dey strong and e get mind; e know book and e fine well-well, bikos God dey with am.”