God tell Samuel, “Na how long yu won to dey sorry for Saul? I don rijet am as Israel king. So put olive oil for yor horn make yu dey go. I dey send yu go meet Jesse for Betlehem, bikos I don choose my king from among en sons.”
Make awa oga tell wi yor savant make wi look for anybody wey sabi play jita. Den wen ever di wiked spirit kom from God kon enter yu, e go play di jita and yu go kon dey okay.”
Di next day, one wiked spirit from God enter Saul and e kon dey tok for inside di house. So David dey play di jita for am. E get one spear wey dey Saul hand,