Yu dey great and get pawa; Yu get glory, honor and respet. Evritin for heaven and eart, na yor own and dis na yor kingdom. Wi dey praiz Yu pass evritin for dis world.
“Mi God don tok. Di time don rish for mi to do wetin I won do. I nor go let una sin finish kon go like dat or sorry for una. I go ponish una for wetin una don do.” God wey get pawa don tok.
God vois bi like lion own from Mount Zion; en vois dey make nois from Jerusalem and di eart with di sky kon dey shake. But God go defend and protet en pipol.
But e tell mi, “Di grace wey I give yu strong rish, bikos my pawa dey show wen yu dey weak.” So, I go boast well-well about how I nor dey strong, so dat Christ pawa go dey show for my body.
Na di God wey go dey forever bi una guide and provida. En hand wey go dey forever, dey support una. E drive all una enemies kon sey make una distroy dem!
God nor dey lie! So di promise wey E make and ensef wey E take swear, na two tins wey nor go shange. Since wi don run go meet God make E guide us, e good make awa mind strong, so dat wi nor go fear as wi bilive en promise.