1 Samuel 14:52 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
52 All di time wen Saul dey alive, e always dey fight with Filistia pipol. So wen ever Saul si pesin wey strong and get mind, e go add am join en sojas.
Filistia pipol gada to fight Israel pipol; dem get 3,000 shariot, 6,000 men for horse and dia sojas plenty like san-san wey dey wotaside. Dem kon go kamp for Mikmash wey dey di east side for Bet-Aven.
Afta Saul don bikom Israel king, e fight all dia enemies wey dey round dem wey bi: Moab, Ammon and Edom pipol, Zobah king and Filistia pipol. Anywhere e for go fight, God dey make am win.
E sey, “E get di way di king go take rule una; e go turn una shidren to sojas; some of dem go bi savant for en shariot and odas go dey run follow di horse.