Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Samuel 14:47 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

47 Afta Saul don bikom Israel king, e fight all dia enemies wey dey round dem wey bi: Moab, Ammon and Edom pipol, Zobah king and Filistia pipol. Anywhere e for go fight, God dey make am win.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Samuel 14:47
17 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Di senior one born boy and e kon koll am Moab wey bi Moab pipol papa.


Di junior one born boy too and e kon koll am Ben-Ammi and na-im bi Ammon pipol papa.


Dis na di shidren wey Esau (wey bi Edom) born.


All dis na Esau (wey bi Edom) sons and dia shiefs.


So Esau (wey still bi Edom) kon go stay for di hill for Seir.


Jonatan arrow nor stop to flow with pipol blood; e even skata strong wariors flesh. Saul swod nor taya to distroy many pipol for groun.


Wen Ammon pipol si sey dem don make David vex for dem, dem kon go Aram Bet-Rehob and Aram Zobah go hire 20,000 sojas wey dey waka for groun, plus 1,000 men from Maaka king and 12,000 men from Tob.


David rule evriwhere for Israel and e make sure sey dem trit evribody well with betta mind.


David still win King Hadadeza wey Rehob bi en papa, wey dey rule Siria for Zobah wen King Hadadeza dey go take-ova Uppa Eufrates for di river aria.


God still make Rezon wey bi Eliada pikin, turn against Solomon. Rezon run from en oga, King Hadadeza for Zobah


Bikos God nor won skata Israel pipol kom from di eart, E kon save dem thru Joash pikin, Jeroboam.


Naw, make una listin! Na dis king go lead una. I don old and get white hair full body, but my sons dey with una. I don dey lead una since wen I yong kon rish today.


Saul na thirty years wen e start to rule; e rule for more dan forty years.


Den Saul stop to porshu Filistia pipol and dem kon go back to dia house.


All di time wen Saul dey alive, e always dey fight with Filistia pipol. So wen ever Saul si pesin wey strong and get mind, e go add am join en sojas.


One of Saul savant dey der dat day, bikos e nid to do some tins wey God tell am. En name na Doeg wey kom from Edom and na en dey kare for Saul animals.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ