Wen Profet Mikaya rish where King Ahab dey, di king ask am, “Profet Mikaya, ‘Make mi and King Jehoshafat go attack Ramot for Gilead?’ ” Mikaya ansa, “Make una go attack am, bikos God go give una viktory.”
“Man pikin, tell dis men wetin God wey get pawa dey tok: Una don kom ask wetin I wont, abi? As long as I bi di God wey dey alive, I nor go let una ask mi anytin. Mi, wey bi God wey get pawa, don tok.
and na Finehas, wey bi Eleazar pikin and Aaron grand-pikin, bi di priest wey dey kare for am). Den Israel pipol ask God again, “Make wi go fight against awa rilative for Benjamin tribe or not?” God ansa. “Make una go! Tumoro, I go give dem to una.”