I don kom diliver dem from Egypt pipol, den karry dem go anoda land wey dey good and big. Di land wey milk and honey dey flow for di aria where Kanaan, Hit, Amor, Periz, Hiv and Jebus pipol dey stay.
Bikos if Yu distroy dem, Egypt pipol go sey, ‘God nor fit karry dem go rish di land wey E promise dem and bikos God hate dem well-well, E take dem komot here go kill for di wildaness.’
E take some of di honey for en hand kon dey lick am as e dey waka go. Den e take some go give en papa and mama. Dem lick am, but Samson nor tell dem sey na from lion dead body e for take am.
Naw, di men for Israel don dey hongry, bikos Saul make dem swear sey: “E nor go betta for any man wey go chop food before evening! Make nobody chop anytin until I don revensh my enemies!” So nobody chop anytin