1 Samuel 13:18 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
18 anoda group face di road wey go Bet-Horon and di last group kon dey waka go di road wey go di borda where dem for dey si Zeboim Valley for di desert side.
kon gada go fight, Bera wey bi Sodom king, Birsha wey bi Gomorrah king, Shinab wey bi Admah king, Shemeba wey bi Zeboiim king and Bela king (di place wey dem also dey koll Zoar).
Efraim pipol, how I won take leave or abandon una? I nor fit distroy una just as I distroy Admah pipol or trit una as I trit Zeboiim pipol? My heart nor go let mi do am, bikos di love wey I get for una, too strong.
God make dem fear as dem si Israel pipol. Israel pipol really kill dem for Gibeon der. Israel pipol porshu dem pass Bet-Horon kon dey kill dem until dem rish Azeka and Makkedah.
As dem dey run from Israel pipol go di low groun for Bet-Horon, God kon make big-big stone dey fall from sky for dia head go rish Azeka. Dem die well-well and di ones wey di stone kill, many pass doz wey Israel sojas kill.