Afta God don tok finish with Job, E kon tell Elifaz sey, “I dey vex with yu and yor two friends, bikos yu nor tok di trut about mi, as my savant Job do.
Na nite wen I dey sleep Yu take test my mind kon shek my heart. Yu don shek mi kon si sey I nor dey wrong. I don sey I nor go sin with wetin I dey tok or do.
So kworel kon start between dem and some oga for di law matter wey bi Farisee pipol kon stand up dey oppoz di Sadusi pipol sey, “Wi nor si any bad tin wey dis man do. Una know weda na spirit or angel tok to am?”
Wi dey happy, bikos wi know sey di way wi dey live awa life for dis world and how wi dey bihave with una, dey show sey na God send us thru en pawa, nor bi human being own.