God go karry una with di king go meet pipol wey una with una grand-grand papa neva hear of before and una go serve and woship gods wey dem make with wood and stone.
If una go against di Oga una God kovenant wey E kommand make una keep kon follow, woship and dey bow to oda gods, God go vex for una well-well and una go kwik-kwik vanish komot from dis good land wey E give una.”