Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Samuel 12:2 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

2 Naw, make una listin! Na dis king go lead una. I don old and get white hair full body, but my sons dey with una. I don dey lead una since wen I yong kon rish today.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Samuel 12:2
17 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Naw wey I don old well-well, make Yu nor leave mi. Make I tell dis new generashon and all doz wey dey porshu mi about yor pawa.


pesin wey go-go out before dem and kom back before dem and wey go lead dem, so dat God pipol nor go bi like sheep wey nor get who dey guide dem.”


For mi, I don already use my life as ofrin for God work, bikos di time wey I go die, don near.


E don tey since God don give Israel pipol rest from dia enemies and Joshua don old well-well.


So Joshua gada all di pipol, plus di eldas, rulers, judge and leaders kon tell dem sey: “I don old well-well.


as I know sey di time wey I go die don near, bikos awa Oga God Jesus Christ don show mi.


Naw, wen Eli don old well-well, e kon dey hear evritin wey en boys dey do to evribody for Israel and how dem dey sleep with wimen for di temple door-mot.


So wetin make dem get long-trot for di sakrifice and ofrin wey I sey make dem put for where I dey? Eli, yu don honor yor boys pass mi, bikos yu don make dem fat from di best part of meat from all di ofrin wey my pipol for Israel dey bring.’


Den God kom near and koll am as before, “Samuel! Samuel!” So Samuel ansa, “Tok to mi, yor savant dey listin!”


Make yu tell am sey, I won judge en family forever, bikos of di sins wey en ensef know about. Bikos en boys shidren dey curse God and e nor stop dem.


Eli koll Samuel kon sey, “Samuel my pikin!” Samuel ansa, “Si mi here.”


Wen Samuel don old, e kon sey make en sons dey judge Israel pipol.


Dem dey sey, “Wi won bi like oda nashons. Awa king go judge and lead us and e go fight awa fight.”


But en boys nor follow wetin e tish dem, instead dem dey take bribe and nor dey judge well.


kon tell am, “Si, yu don old and yor shidren nor dey do as yu dey do. So make yu choose king wey go lead us, just as all di oda nashons get.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ