1 Samuel 11:15 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
15 So di pipol kon go Gilgal, di place where dem for make Saul dia real king for God present. Dem offa peace ofrin give God for der. Saul and evribody for Israel kon dey happy.
Samuel tell di pipol, “Una don si di pesin wey God don choose? True-true, nobody bi like am for di whole Israel!” All di pipol kon shaut, “Di king go stay forever!”
“Yu go-go Gilgal before mi. I go kom meet yu for der kon offa ofrin and make peace ofrin for der. Yu go wait for seven days, until I go kom tell yu wetin yu go do.”
Abi nor bi di time to harvest grain bi dis? I go koll God, so dat E go send betta tonda and rain kom. Make una open una eye kon si how una don sin rish, wen una ask God for king wey go lead una.”