Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Samuel 11:13 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

13 But Saul ansa, “Una nor go kill anybody today. Bikos God don make Israel pipol win!”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Samuel 11:13
11 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

But David tell Abishai and Joab en broda, “Who make una judge? Yu won give mi trobol? Na mi bi Israel pipol king naw and nobody go kill Israel pesin today,”


Den e tell Shimei, “I promise yu sey nobody go kill yu.”


e stand fight till en hand bigin pain am and en swod kon gum en hand. God give dem viktory dat day. Wen Israel pipol go meet Eleazar afta di fight, di only tin wey remain for dem to do, na to kollect all di tins wey Filistia sojas die leave.


Moses kon tell di pipol, “Make una nor fear! Make una get faith and una go si how God go take save una; bikos dis Egypt sojas wey una dey si today so, una nor go ever si dem again.


So for dat day, Oga God save Israel pipol from Egypt pipol hand. Leta, Israel pipol kon si Egypt pipol dead body for di wotaside.


E dey sopraiz am sey, nobody dey to help pipol wey dem dey opress. So E go save dem with en own pawa kon make dem get viktory.


But God kind! I bi wetin I bi and God mesi for mi, nor bi yeye tin. I dey work pass any oda apostle; aldo na God grace dey help mi.


But some wiked pipol sey, “How dis man go fit take save us?” Dem curse am and dem nor gri kom gi-am gift. But Saul nor tok anytin.


But di sojas sey, “Make Jonatan wey win dis war for Israel, die? E nor go ever happen! As long as God dey alive, one hair for Jonatan head nor go even fall rish groun! Bikos na with God help, e take do wetin e do today.” So di sojas nor let dem kill Jonatan.


E risk en life wen e fight and kill Filistia pipol. God win big viktory for Israel pipol. Wen yu si and hear am, yu yorsef kon dey happy. So wetin go make yu won sin against pesin wey nor do any bad tin? Wetin go make yu won kill David yor savant for no rizin?”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ