Wen God porshu dem komot, E kon put angels for di gate for di east side for di gardin with one swod wey dey bring fire and e dey turn face evriwhere. Dis one na to stop anybody wey won go near di tree wey dey give life.
But God tell Samuel, “Make yu nor happy, bikos of how en face look, bikos nor bi en I choose. God nor dey si tins di way una dey si am. Pipol dey look pipol from how dem bi for outside, but God dey look pipol from how dem bi for dia heart.”
E get one man from Benjamin tribe, en name na Kish and en papa na Abiel wey Zeror born and na Bekorat wey en papa na Afia from Benjamin tribe, born Zeror. Dem know Kish well-well for evriwhere.