Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Samuel 10:22 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

22 So dem kon ask God again sey, “Di man don rish here?” God ansa, “E hide ensef for back of di tins wey dem dey supply.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Samuel 10:22
19 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

But di shidren kon dey struggol inside am, so di woman kon sey, “If na so e go bi, I nor sure sey I like get belle!” So di woman ask God


Afta dis, David ask God, “Make I go stay one town for Judah?” God ansa am, “Yes! Yu fit go.” David ask again, “Na wish one?” God ansa, “Na Hebron.”


Wen David bi king, strong honga kon dey and e last for three years. So David ask God and E ansa am sey, “Saul and en family dey guilty, bikos dem kill pipol. Dem kill Gibeon pipol.”


E go stand before Eleazar wey go-go hear from God akordin to di Urim. Akordin to en kommand, dem go-go out and kom in, both en and all Israel pipol.”


Anybody wey dey karry body up, dem go bring am down and anybody wey put en body for groun, dem go karry am up.”


Afta Joshua die, Israel pipol kon ask God, “Na wish tribe go first go attack Kanaan pipol?”


Before dem go for di war, Israel pipol go Bethel go ask God, “Na wish tribe go first attack Benjamin pipol?” God ansa, “Make Judah go first.”


Bikos dem don go Bethel go kry for God present till evening kon dey sey, “Make wi fight against awa rilative for Benjamin tribe again?” God ansa dem, “Make una go fight dem.”


and na Finehas, wey bi Eleazar pikin and Aaron grand-pikin, bi di priest wey dey kare for am). Den Israel pipol ask God again, “Make wi go fight against awa rilative for Benjamin tribe or not?” God ansa. “Make una go! Tumoro, I go give dem to una.”


Den e bring Benjamin tribe akordin to family and na Matri family dem choose. At last, dem kon choose Kish pikin wey en name na Saul wen dem trow di dice. But wen dem look for am, dem nor si am.


So Saul ask God, “Make wi porshu Filistia pipol? Yu go give dem to us?” But God nor ansa am dat day.


Samuel sey, “Even doh yu feel sey yu nor dey important, yu still bikom God pipol king. Na God choose yu as king ova en pipol.


E tok to God for am kon give David some food and oda tins. E still gi-am Goliat, di Filistia giant, swod.”


Wen David hear wetin Saul dey plan to do am, e kon tell Abiatar wey bi priest sey, “Make yu bring di efod kom.”


Den David tell priest Abiatar wey bi Ahimelek pikin, “Bring di efod kon give mi.” So Abiatar bring di efod kom.


So David ask God, “Make wi porshu dem? Wi go katch dem?” God ansa, “Make una porshu dem, una go true-true katch dem kon diliver una wifes and shidren.”


Saul ansa, “Na Benjamin tribe wey small pass for Israel, I from kom and na my family small pass for Benjamin tribe, wetin kon make yu dey tok to mi like dis?”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ