So, Jeftah follow Gilead leaders go back and di pipol kon make am dia leader and ruler. Jeftah tell dem wetin e wont wen dem dey God present for Mizpa.
Israel pipol for nort for Dan kountry go rish Beersheba for sout and even Gilead land for east, ansa di koll. Dem gada togeda as one for God present for Mizpa.
So di pipol kon go Gilgal, di place where dem for make Saul dia real king for God present. Dem offa peace ofrin give God for der. Saul and evribody for Israel kon dey happy.