1 Samuel 1:24 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
24 So di woman stay with en pikin until e kon big. Wen Hannah don train am rish, e kon karry am with three melu, one bag of flower and one kontaina of wine, go God house for Shiloh.
Jesus still tell dem anoda parabol: “God Kingdom bi like yist wey one woman take bake bread. E mix am with plenty flower and di small yist kon make di bread raiz well-well.”
una must bring evritin wey I kommand una: una burnt ofrin; sakrifice ofrin; tithe and vow ofrin kom di place wey God choose as where dem go for woship and honor en name.
For evry year, evry man for Israel go dey celebrate dis three feast: Bread wey nor get yist, Harvest Feast and Shelta Feast. For each feast, evribody must karry gift kom give di Oga una God for di place wey E choose.