Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Pita 4:8 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

8 As una dey do so, make una love for each oda dey strong, bikos love dey kover plenty sins.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Pita 4:8
17 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Na only trobol bad belle dey kause, but love dey kover evry sin.


Foolish pipol dey kwik vex, but wise men nor dey tok even wen dem curse dem.


If yu wont make pipol like yu, den forgive dem if dem do yu bad. Remember sey bad tin fit skata friendship.


Make yu dey listin well before yu ansa, If not, e go bi like sey yu bi stupid pesin wey nor get respet.


If I dey tok di language wey human being and angels dey tok;


Love dey kind and patient, e nor dey jealous or boast


With all dis good tins, make una love one anoda, bikos na love bi di best tin wey fit whole una togeda.


Make Christ make una love for each oda and for evribody, grow more-more and big, just as awa love for una bi,


Wi get betta rizin to dey tank God evritime for una, bikos una faith dey grow more-more and di love wey una get for each oda, dey grow too.


But di rizin why I dey give dis kommand, na bikos I love dem from my heart with betta mind and faith.


Make una dey love each oda like Christian brodas and sistas.


My brodas and sistas, make una remember dis kommand pass oda ones; make una nor swear, weda with heaven or eart or any oda tin. But make una let una “Yes” bi yes, and una “No” bi know, so dat una nor go fall enter God judgement.


make yu know sey, di pesin wey bring yu wey bi sina kom back from di bad way, don save yor soul from deat and e don make Christ forgive yu all yor sins.


Una don klean una soul with di trut wey una dey obey and as brodas and sistas, make una love each oda well-well.


My friend, I dey pray sey make evritin dey good for yu and make yor body well, just as yor soul well too.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ