“Naw, mi wey bi God wey get pawa dey tell Israel pipol sey I go judge evribody akordin to wetin e do. So make una turn from sin and all di bad tins wey una dey do, so dat una sins nor go distroy una.
So e koll di manaja kon tell am, ‘I nor like wetin I dey hear about yu. Make yu go rite how yu take dey spend all my money, bikos yu nor go bi my manaja again.’
I dey tell yu wetin to do for God and Jesus Christ present. Wen Christ go appear to make en kingdom stand, e go judge pipol wey dey alive and doz wey don die.