Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Pita 4:4 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

4 Naw, doz unbilivers dey sopraiz and curse una, bikos una nor dey follow dem do bad and wiked tins again.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Pita 4:4
11 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

“E go bad for una wey dey tish di law and una Farisee pipol, una wey dey pritend! Una dey wosh cup and plate body make dem for klean, but bad belle and long-trot full inside una.


“Afta sometaim, di yong boy karry evritin wey e get travel go one far kountry kon waste all en money for yeye life.


But wen di Jew pipol si as di pipol plenty rish, jealousy kon full dia mind, so dem start to oppoz wetin Paul dey tok kon dey curse am.


Wen dem oppoz and curse am, e shake en dress kon sey, “Make una blood dey una head, bikos I nor do any bad tin and from today go, I go-go prish for Gentile pipol!”


So make wi dey bihave well as pipol dey do for day time. Nor go anyhow party or drink too mush, den kon dey bihave anyhow. Nor kworel or judge pipol.


Make una nor dey drink strong drink, bikos e go distroy una. But make una allow God Spirit fill una mind.


So make una dey live well among pipol wey nor bi Christian, so dat wen dem sey una do bad, dem go si di good tins wey una dey do and dem go praiz God wen E won judge di world.


But make una do am with gentolness and respet, dey make sure sey una mind klean, so dat pipol wey dey tok bad about di good tins wey una dey do for Christ, go shame for di bad wey dem dey tok.


But dis men bi like animal wey nor dey tink; animals wey pipol fit kill anyhow and dem just dey do as dem like. Dis pipol dey tok anyhow and na distroshon go end dia life.


Na dem bi ezample for dis word wey pipol tok, “Dog dey go back go chop en vomit,” and “Pig wey dem don wosh en body, go still go liedan for portor-portor.”


But dis pipol nor undastand wetin dem dey tok and dis na wetin dem suppose to undastand without sey pesin tish dem. As animals nor dey tink before dem do tins, na so dis pipol dey bihave.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ