bikos for dat time, di sofa wey go dey, go strong pass any sofa wey don happen since wen God kreate di world kom rish naw and dis kind sofa, nor go dey again.
“Den, dem go ansa, ‘Oga God, wish time wi si yu dey hongry or won drink and wi nor give yu food or sometin to drink, wish time yu bi strenja or naked or nor well or dey for prison and wi nor give yu wetin yu wont?’
Jesus ansa, “Who bi di manaja wey get sense and nor dey do wayo? Na pesin wey di oga put make e kare and give di oda savants dia food for di rite time?
Dis na wetin dem really won do. Bikos wen den share di tins wey dem get with Jew pipol, den dem don follow Jew pipol share dia spiritual blessings too.
Wetin make una tink sey, una betta pass anoda pesin? Nor bi God give una evritin? So wetin make una dey boast wen e bi sey evritin wey una get, na God give una?
Na mi small pass for all God pipol, but God don give mi grace to prish di Good News give Gentile pipol and dis grace wey Christ give mi, nor dey finish.
Make pesin wey bi leader nor get fault, bikos na God work e dey do. Make e nor dey karry body up; dey kwik vex or drink anyhow; dey like to beat pipol or love money.
God nor dey support pipol anyhow. E go remember how una help en pipol before-before and how una still dey help dem naw. Una bi God pipol and E nor go forget di love wey una show en shidren.
I tell my dear broda Silas sey, make e help mi rite dis small leta, so dat una heart go strong and make e tell una sey, all wetin dey happen to una, na as God wont am. So make una stand strong with en pawa.