Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Pita 3:5 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

5 Di wimen for olden days dey holy, bikos dem put dia hope for God hand and dem respet dia husband.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Pita 3:5
17 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Who go fit find wife wey get good karata? Good wife betta pass gold.


Gold dey deceive pipol and beauti dey disappear, but make pipol praiz woman wey dey honor and fear God.


Shidren wey nor get papa and mama, make yu leave dem for mi and I go kare for dem. Wimen wey nor get husband, make dem make dem kom meet mi and I go help dem.”


E don rish eighty-four years since en husband die. E nor dey komot for di temple, e dey serve God and dey fast and pray day and nite.


Dem kon dey pray togeda evriday with one mind, with all di wimen, plus Mary, Jesus Christ mama and en brodas.


One woman dey for Joppa wey bi Jesus Christ disciple and en name na Tabita (wey mean Dorkas for Greek language). E dey do good tins and dey help poor pipol.


So, each man suppose love en own wife, just as e love ensef and evry wife suppose respet en husband.


Instead, make dem get good karata as wimen wey dey fear God, suppose bi.


But God go save di woman wen e won born, so-far e kontinue to get faith, love, holiness and dey kontrol ensef.


Evribody go know am for di good work wey e dey do sey: e don train shidren; dey welkom strenjas; dey serve God pipol; dey help doz wey nor get and e dey do difren good work.


Naw, woman wey en husband don die and e really dey alone for dis world, dey trust God. E dey pray for nite and day sey make God help am.


Na faith make Abraham born, even doh Sarah don too old to get belle and Abraham don old too, but e know sey di Pesin wey promise am pikin, na Pesin wey e fit trust.


Wi tank God wey bi awa Oga God Jesus Christ Papa, for di mesi wey E dey show us. God give us new life thru Jesus Christ wey E wake from deat and naim bi di Pesin wey give us hope.


Hannah kon pray dey sey, “My heart dey happy bikos of God; I dey blow my trumpet loud for God. I dey shaut and happy, bikos God don disgrace and save mi from my enemies.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ