Na mi bi di high and holy God, di Pesin wey go live forever. Where I dey stay, dey high and holy, but I still dey stay with pipol wey dey honbol and ready to turn from sin kom meet mi, so dat I go give dem mind and hope again.
God wey dey mighty, en Spirit dey on mi, bikos E don anoint mi to prish good news give poor pipol; heal doz wey dia heart break; announce make dem release doz wey bi slave and free doz wey dey for prison.
Dis na di message wey Jeremaya give di senior offisa, Seraya wey Mahseaya pikin, Neraya born and na for di time wen e follow King Zedekaya go Babilon for di fourt year wey e bi king for Judah.
but di really Jew na pesin wey bi Jew for inside en heart, bikos sekonsishon nor dey tosh pesin heart. Na di Holy Spirit dey do dis kind work, nor bi di law wey dem rite down and dat pesin go dey receive praiz from God, even doh human being nor praiz am.
So, as pipol wey God don choose, wey holy and wey E love well-well, make una kwik dey sorry for pipol; dey gentol; nor dey karry body up and wear patient like klot for body.
So make una remove una hand from evry dirty and wiked tins kon put una body down to asept God word wey dem don plant inside una, bikos e get pawa to save una soul.
But God tell Samuel, “Make yu nor happy, bikos of how en face look, bikos nor bi en I choose. God nor dey si tins di way una dey si am. Pipol dey look pipol from how dem bi for outside, but God dey look pipol from how dem bi for dia heart.”