Den I ask am, ‘Na wish pesin pikin yu bi?’ Di girl ansa, ‘I bi Betuel wey en papa na Nahor and na Milka born Betuel for Nabor.’ So, I kon put di ring for en nose and di shain for en hand.
For di third day, Estha wear en royal dress kon go stand for di inna kourtyard gate for di palis wey face di throne room and di king sidan for di throne.
Kings dota dey join doz wey kom visit yu and yor kween go wear fine-fine gold and silva wey dem make for Ofir town kon stand near yu for yor rite side!
All di wimen for Israel go ask dia neighbour and Egypt neighbour for gold, silva and fine-fine klot. Una and una shidren go wear dem and like dis, una go finish all di tins wey Egypt pipol get!”
Na both men and wimen kom, dat na di pipol wey dia heart like to give and dem bring dress pins, ear-rings, rings and ornament. Dem still bring difren tins wey dem make with gold as special ofrin to God.
Jerusalem pipol, make una dey great and strong again! God holy town, make una wear pride like klot! Pipol wey nor know God nor go enter una gate again.
Jerusalem pipol dey happy, bikos of wetin God don do. E bi like yong woman wey dem dress ready for marriage. God don wear salvashon and viktory klot for en body.
Jerusalem pipol, naw wey enemies don distroy and porshu una, wetin una go kom do? Aldo una wear red klot and gold kon paint una eye well, but all doz tins nor mean anytin, bikos di pipol wey una love well-well, don rijet and won kill una.
Make una nor bi like pipol for di world, but make una allow God shange una mind, den una go know how to serve God and do tins wey dey make belle sweet am.