Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Pita 3:22 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

22 go heaven kon go sidan for God rite hand, where e dey rule di angels and doz wey get pawa.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Pita 3:22
24 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Di OGA tell my Oga God, “Make Yu sidan for where honor dey for my rite hand, until I don put all yor enemies under yor leg.”


“Di OGA tell my Oga God sey, ‘Sidan for my rite hand, until I go put all yor enemies under yor leg.’


Den Jesus Christ waka near kon tell dem, “God don give mi all di pawa wey dey heaven and eart.


Di Holy Spirit pawa make David tok sey, “ ‘God tell my Oga God, sidan for my rite hand until I go put yor enemies under yor leg.’


Afta Jesus don tok to dem finish, God kon karry am go heaven and e sidan for God rite side.


Bikos David ensef tok for Psalms Book sey, “ ‘God tell my oga sey, “Sidan for my rite hand,


Wen di pikin don honor God, God go honor am too.


kon sey, “Galilee pipol, na wetin make una stand der dey look heaven like dat? Dis Jesus Christ wey God don karry go heaven today, go still kom back di same way wey una si am dey go heaven.”


Dis Jesus Christ go stay for heaven till di time wey God go make evritin betta again as E don tok thru en holy profets.


Who bi di pesin wey go kondemn us? Na Jesus Christ wey die for us; di pesin wey God raiz from deat and naw, e dey for God rite hand side dey pray for us.


But I dey sure sey, weda na deat or life; angels or wiked pawas; tins wey dey naw or di ones wey dey kom;


Den afta Christ don distroy all pawas, di world go end and e go give di kingdom to God wey bi di Papa.


So, if God raiz una with Christ, den make una put mind for tins wey dey heaven; di place where Christ for sidan for God rite side.


Na wish angel God tell, “Sidan for my rite hand until I go put all yor enemies under yor leg?”


Na dis pikin bi God image and e dey show God glory. Naim dey keep evritin wey dey dis world with en pawa. Afta e don die make God for forgive evribody dia sins, e kon go sidan for God rite side for heaven.


But wen God won send en first-born enter dis world, E sey: “Make all my angels woship am.”


But naw, Christ offa only one sakrifice for sin wons and for all, den e kon go sidan for God rite hand,


Make wi dey look Jesus Christ wey give us awa faith and go help us keep am. Bikos of di joy wey Jesus dey espect, e sofa for cross and nor mind di shame wey follow am. But naw, e don sidan for di rite hand side for God throne.


Jesus wey bi God Pikin, na-im bi awa High Priest wey don go heaven. Make wi hold am tait and always dey bilive am.


di place where Jesus don enter for us and don bikom High Priest forever, just as Melkizedek bi.


Wetin I mean bi sey: Wi get High Priest wey sidan for God rite hand side for heaven.


Christ nor enter di Holy Place wey human being build like di original building for heaven, but na heaven e enter and naw, e stand for God present for awa sake.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ