Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Pita 3:2 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

2 wen dem si una good karata and how una life pure rish.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Pita 3:2
13 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

So, each man suppose love en own wife, just as e love ensef and evry wife suppose respet en husband.


Una wey bi savant, make una dey obey una masta with fear, respet and with klean mind like sey, na Christ una dey obey.


Make una life dey show sey una bilive Christ message, so dat weda I kom si una or not, I go dey hear sey una dey strong with one spirit, one mind and dey fight togeda make di gospel for stand.


But wi bilong to heaven and wi dey wait awa Savior wey kom from der, wey bi Oga God Jesus Christ.


Una wey bi savants, make una obey una mastas (dey do wetin dem tok) for evritin and nor bi only wen dem dey look una. Make una nor dey do like pipol wey wont make dem praiz dem, but make una dey obey with betta mind, bikos una dey fear God.


Nor let anybody opress yu bikos of yor age; but make yu show ezample to doz wey bilive thru yor word, karata, love, faith and as yu pure rish.


But for evritin wey una dey do, make una dey holy like di Pesin wey koll una,


So make una dey live well among pipol wey nor bi Christian, so dat wen dem sey una do bad, dem go si di good tins wey una dey do and dem go praiz God wen E won judge di world.


Make una wey bi wife, dey obey una husband. Even doh dem nor dey do wetin dem rite for God word, di way una dey bihave, fit make dem shange,


Make una beauti nor bi di one wey pipol dey only si like: to dey plait hair; dey wear gold or fine klot.


Since evritin go melt like dis, wish kind pipol wi suppose to bi? E good make wi dey live awa life for holiness and dey do wetin God wont.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ