“ ‘Afta di sixty-two weeks, di Pesin wey God choose, go die and nor-tin go remain. Di ruler wey get pawa pass, go bring sojas kom distroy di town and di temple. Di end go rush kom like wota; e go bring war and distroshon, just as God plan am.
Zion pipol! Make una happy well-well! Jerusalem pipol! Make una shaut with joy! Make una look, una king dey kom meet una! E dey raitious and naim get viktory. E dey honbol and kwayet as E sidan on-top donkey dey kom.
As Pilate sidan for di judgement seat, en wife send message go meet am sey, “Nor put hand for dat innocent man matter, bikos last nite, I dream bad dream about am.”
Wen Pilate si sey di pipol nor gri and trobol won start, e kon take wota wosh en hand for di pipol front dey sey, “Dis man blood nor dey my head. Make only una go kill-am!”
Den e sey, ‘God wey awa grand-grand papa dem serve don already choose yu to do wetin e wont, so dat yu go take yor eye si di Raitious Pesin. So make yu hear and listin to am,
If God Spirit wey raiz Jesus Christ from deat dey inside una, den en wey raiz Christ from deat, go give una body life, bikos of en Spirit wey dey inside una.
Moses Law nor fit do dis tins, bikos di yeye life wey wi dey live don make di law weak. But God don free us wen E send en pikin kom like human being wey bi sina, make e for sakrifice ensef for awa sins.
True-true, bikos e nor show en pawa, na dat make dem fit nail am for cross, but e dey alive naw, bikos of God pawa. Aldo wi dey weak with am, but wi go dey alive togeda with am, bikos of God pawa wey wi get.
Christ don save us from di curse wey di law bring, bikos e die for cross for us (just as dem rite am, “Anybody wey dem hang for tree, curse dey en head”),
wot of Christ blood wey klean us from deat, so dat wi go fit woship God? Dis na di Christ wey offa ensef to God as di rite sakrifice for awa sins and e do am with di Holy Spirit pawa.
bikos if na so, Christ for dey kom die for us evry year since di time wey God kreate di world. But nor bi so! E die wons and for all, so dat awa sins go-go forever.
Na dis make Christ prish di gospel for doz wey don die, so dat even doh e go judge dem as human being, dem go live forever as spirit thru God judgement.
But if wi konfess awa sin to am, e go forgive us kon wosh evritin wey nor good for God eye komot from awa life, bikos Christ dey always do wetin e sey e go do, since e dey raitious.