Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Pita 3:12 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

12 God dey si di pipol wey dey do good and en ear dey open to hear dia prayers. But E dey against pipol wey dey do bad.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Pita 3:12
21 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

E klear sey na God dey wosh di whole world and E dey ready to give pawa to doz wey trust am. Yu nor use sense for dis matter, so from naw go, na so-so war yu go dey fight.”


I go listin and ansa dia prayers wey dem go pray for dis place.


But God dey for en holy temple; E dey rule from heaven. E dey look as evribody dey live dia life for dis eart.


But God dey guide doz wey dey fear am; doz wey bilive en love wey nor dey fail.


Bikos Yu hear and ansa awa prayers; so evribody go kom meet Yu.


Make awa enemies nor chop and burn us finish. Make dem die, bikos Yu nor dey happy with dem.


God dey far from wiked pipol, but E dey hear raitious pipol prayer.


God dey wosh evriwhere, E dey wosh both good and wiked pipol.


God hate wiked pipol sakrifice, but E dey enjoy good pipol prayers.


Bikos I don make up my mind sey I nor go sorry for dis town, so I go distroy am. I go gi-am to Babilon king and e go burn am rish groun. Mi, wey bi God, don tok.”


E tell am, “Make sure sey Jeremaya nor wound and yu go kare for am kon gi-am anytin wey e wont.”


and ponish Jerusalem pipol. Dem don eskape one fire, but naw, betta fire go burn dem finish. Wen I don ponish dem, den una go know sey na mi bi God.


“ ‘If any Israel pesin or strenja wey dey stay for di land chop meat wey still get blood, God go turn against am and e nor go dey among God pipol again.


Mi mysef go turn my face against dat pesin kon remove am from my pipol, bikos e don give en pikin to Molek juju and like dat, e don spoil my temple kon disgrace my name.


“ ‘Di pesin wey dey go meet dead body spirit for advise, I go turn against am kon remove am from my pipol.


I go turn against una kon make una enemies win and di pipol wey hate una, go rule una. Fear go katch una sotey una go dey run wen nobody dey porshu una.


Make una nor laf as una take start small, bikos God dey happy sey di work don start and E dey happy to si di ruler for Zerubabel hand.” (Di seven lamps na God eyes wey dey look di whole world.)


Wi know sey God nor dey listin to anybody wey dey sin, but if pesin dey do wetin God tok, God go hear en prayer.


di kind land wey di Oga una God like well-well. From one year to anoda, God dey wosh ova di land!


So make una konfess una sin to each oda. Make una pray for each oda, so dat God go heal una. Di prayer wey pesin wey good for God eye take all en mind pray, dey work well-well.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ