Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Pita 3:10 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

10 God word sey: Anybody wey won enjoy good life, must kontrol en mout; make e nor dey tok bad-bad tins or lie.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Pita 3:10
24 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Satan ansa, “Di true bi sey, pesin go give Yu evritin wey e get, so dat e nor go die.


E don save mi from deat and I still dey alive.


“No day good for my life since dem born mi and dem nor dey last.


Make I share for di joy wey Yu dey give to di pipol wey Yu choose. Make I happy, bikos yor pipol dey happy; make I praiz Yu with doz wey bi yor own.


But where I for dey naw, if to sey I nor bilive sey God go favor mi for dis land wey wi dey?


but dem go die like doz wey don die before and dem nor go ever si day lite again.


Wisdom na tree wey dey give life and e dey make pipol wey kom meet am, happy.


Wetin I tish yu go make yu prosper and get long life.


Bikos dem dey give life and betta body to anybody wey undastand dem.


Doz wey find mi, go get life and God go favor dem.


I really tink well-well about wetin wine go fit do for mi. I bilive sey na wisdom I dey use and I nor go bihave like fool, so dat I go know wetin dey good for pipol to do for dis world, as dem dey live dia life wey go soon end.


Jesus ansa am, “Why yu dey ask mi about wetin good? Na only God good. So if yu wont enter heaven, make yu keep God kommandments.”


Bikos anybody wey won save en life, go luz am and anybody wey luz en life bikos of mi and dis gospel, go save am.


Wen Jesus si Netanel dey waka kom meet am, e kon sey, “Make una look! Dis na betta pesin wey kom from Israel, wayo nor dey en belle.”


Anybody wey love en life for dis world, go luz am, but di pesin wey nor love en life for dis world, go get life wey nor dey end.


All dis nor bi ordinary word, but dem dey give life! Wen una obey dis word, una go get long life for di land wey una go soon cross Jordan River enter.”


If anybody tink sey en dey follow wetin wi dey tish and e nor fit kontrol en mout, dat pesin dey deceive ensef and en relijon nor mean anytin.


Make una stop to do bad tin; dey deceive pipol, pritend; dey jealous and tok bad about pipol.


Lie-lie nor dey dia mout and dem nor get any fault.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ