God kon tell di woman, “Wen yu dey labor, I go make am pain yu well-well. Na inside pain yu go take born shidren. Yu go won kontrol yor husband, but na-im go bi yor head.”
To make peace with yor broda wey yu offend, hard pass to break enter town wey dem guide well-well and kworel, dey separate friends like gate wey dem lock with key.
Husbands, make una dey trit una wife with soft hand, bikos una know sey dem nor strong rish una; make una respet dem as pipol wey get God grace and life. If una dey do like dis, nor-tin go block una prayers.