Di Shepad for Israel, make Yu listin to us. Yu wey dey kare for Josef shidren-shidren, just as shepad dey kare for en sheep. My God wey high pass di angels, make Yu show yor glory wey dey shine
But dem wound am bikos of awa sin; dem beat am bikos of di bad tins wey wi do. Na di ponishment wey e sofa give us peace and en wounds don make us well.
Dis na wetin di Oga wey bi Israel God tok about di rulers wey suppose kare for en pipol: Bikos una nor kare for my pipol and una skata and drive dem komot, I go ponish una for di wiked tins wey una do.
Make una take kare of unasef and all di pipol wey di Holy Spirit don put under una, bikos na una bi di leaders for God church wey E buy with en only pikin blood.