“But e go bad for una wey dey tish di law and una Farisee pipol, una wey dey pritend! Una klose door make pipol nor for fit enter God Kingdom! Unasef nor won enter and una nor won make odas enter.
Slave wey God choose make e follow Jesus, don bikom free man thru Jesus Christ. So free man wey God choose make e follow Jesus, don turn to Christ savant.
Make una nor bi like pipol wey dey do dia work wen dem si sey, pesin dey look dem; bikos dem dey fine good face. Instead, as una bi Christ savant, make una dey do wetin God like from una heart.
But di pesin wey dey look God pafet law wey dey free pipol; dey do wetin di word tok and e nor dey listin and forget, God go bless am for evritin wey e dey do.
Even doh dis fake tishas dey promise dis pipol sey, dem go dey free, di fake tisha na slave dem bi to sin. Bikos pesin na slave to anytin wey masta am.
Some pipol don hide join una and God don mark dem for distroshon. So I won tell una about dis tins sey, dis pipol nor dey fear God. Dem don dey use God grace as eskuse to dey do bad-bad tins. Dis pipol nor gri asept Christ as dia Masta and Oga God.