Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Pita 1:8 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

8 Aldo una neva si am, but una love am. Una nor dey si am naw, but una bilive am, una get happiness and glory wey una nor go fit esplain.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Pita 1:8
37 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

My love, make yu tell mi! Na where yu won go feed yor animals today? Where yor sheep dem go for rest dis aftanoon? Make yu tell mi, if not I go dey waka up-and-down like ashawo for where yor friends and dia animals dey!


En mout sweet well-well to kiss and evritin about am, dey sweet mi for body. So, Jerusalem wimen! Dis na wetin my love bi like.


Woman wey fine well-well, wetin make yu tink sey yor love betta pass oda men? Wetin dey good about yor love, wey go make us promise yu?


“Anybody wey love en papa, mama and pikin pass mi, nor go fit bi my disciple.


“If una love mi, una go do wetin I tok.


Anybody wey hear and do wetin I tok, love mi. Di pesin wey love mi, mi and my Papa go love am too and I go show am who I bi.”


Di pesin wey nor love mi, nor go do wetin I tok. Wetin una dey hear so nor bi my word, but na my Papa own.


Na so e bi for una naw, bikos una heart dey heavy, but I go si una again and for dat time, una go dey happy and nobody go fit take di happiness from una.


Den Jesus tell am, “So yu bilive naw, bikos yu don si mi? God go bless pipol wey neva take eye si mi, but dem bilive mi.”


Den Jesus ansa, “If to sey na God bi una Papa, una for like mi, bikos I kom from God and as I dey so, I nor kom do my own tins, bikos na-im send mi.


Di warda bring dem enter en house kon put food for tabol make dem chop. E happy well-well sey en and en family don bilive God.


Bikos God kingdom nor bi food and drink matter, but na about raitiousness, peace and joy wey di Holy Spirit dey give pipol.


I pray make God wey dey give hope, bless una with joy and peace bikos of una faith. So make di Holy Spirit pawa full una body with faith.


Anybody wey nor love Christ, curse dey en head!


and E don mark us as en own kon put en Spirit for awa heart, so dat wi go dey sure of all di oda tins wey E sey E go give us.


God karry am go paradise and e hear tins wey dey too holy to tok; tins wey God nor give human being pawa to tok.


Wi nor dey look for wetin eye fit si, but na wetin eye nor fit si. Bikos wetin eye fit si nor go last, but di tins wey eye nor fit si, dey last forever.


bikos wi dey live awa life with faith, nor bi with wetin wi dey si.


Na dis make us dey tank God for dis gift wey pesin mout nor fit tok.


But di fruit wey di Holy Spirit dey bear inside us; na love, joy, peace, patient, kindness, goodness, faithfulnes,


For Christ, e nor matter weda dem sekonsaiz pesin or not; di only tin wey matter, na faith wey dey work thru love.


Den una go really know di love wey Christ get, wey big pass evritin wey una go fit undastand and evritin inside God, go full una life.


Make God grace dey with evribody wey love awa Oga God Jesus Christ with di love wey nor dey die.


I dey sure of dis tins: I know sey I nor go die naw, so dat I go kontinue with una and as una dey inside di faith, una life go dey betta more-more.


Na wi bi di really sekonsishon; di pipol wey dey woship God thru en Spirit; pipol wey dey happy inside Christ and wi nor dey put awa hope for wetin pipol dey do.


Make una always dey happy inside Christ. I dey tok again sey, make una dey happy!


Faith na wen wi dey sure sey wetin wi dey hope for go happen and wi sure sey, di tins wey wi neva si, go kom.


Na di same faith make Moses komot from Egypt and e nor fear di king vexnashon, bikos e get hope for God wey ordinary eye nor fit si.


Aldo una go sofa small, but dis joy go bring happiness for una.


So, una wey bilive don know en value, but for di pipol and builders wey nor bilive, dat Stone don kon bi di main stone.


So wen di big shepad, Jesus Christ go kom, e go give una crown wey en glory nor go ever fade.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ