Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Pita 1:5 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

5 and en pawa dey protet am thru faith and wi dey wait for di salvashon wey go kom for di time wen di world go end.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Pita 1:5
43 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

But I know sey God dey for heaven and E go kom save mi for di end.


Bikos God like to dey judge well and E nor go ever leave doz wey dey fear am.


E dey protet pipol wey dey trit odas well kon guide doz wey dey respet am.


But God go save Israel and dia viktory go bi forever. Nobody go ever disgrace God pipol again.


So make una look heaven and eart! Di heavens go vanish like smoke, di eart go tear like old klot and all en pipol go die like fly. But wen I diliver am, e go last forever. My viktory, na di final one.


But nor-tin wey pipol use against una, go fit distroy una; una go ovakom evribody wey dey akuiz una. Dis na wetin pipol wey dey serve Mi dey enjoy and I go defend and make dem win.” Na so God tok!


God sey, “Just as di new eart and heaven wey I go make go dey with mi forever, na so too una name and una shidren-shidren name go dey with mi forever.


I go choose rulers wey go kare for dem. My pipol nor go fear at-all and I nor go ponish dem again. Mi, wey bi God, don tok.”


I go make kovenant wey nor dey end with dem sey I nor go ever stop to do good tins for dem and I go make dem fear mi with all dia heart, so dat dem nor go turn leave mi again.


Anybody wey rijet mi and nor do wetin I tok, God go use dis my word judge am for di last day.


I nor sey make yu remove dem from di world, but make yu protet dem from di devil.


But anybody wey go drink from di wota wey I go gi-am, nor go hongry for wota again, bikos di wota wey I go gi-am, go turn to river wey nor dey dry inside en belle and di wota go gi-am life wey nor dey end.”


“I tell una true word, di pesin wey take wetin I tok and bilive sey na di Papa send mi, go get life wey nor dey end and e nor go enter hell-fire, but e go get life wey nor dey end.


True-true, God break Israel pipol komot from di tree, bikos dem nor bilive am. But una dey where una dey, bikos una get faith. So, make una nor dey boast, instead, make una dey fear wetin God fit do.


I dey sure sey, wi nor go fit kompare all di sofa wey wi dey sofa naw, with di glory wey God go give us.


God wise well-well, so E nor let pipol for dis world know am with di wisdom wey dem get. Instead, E save only di pipol wey bilive di foolish message wey wi dey prish.


Wi nor dey try to force una to bilive us; wi know sey una faith strong well-well. But wi dey work with una so dat una go dey happy well-well.


I don die with Christ for cross, so nor bi mi dey live again, but na Christ dey live inside mi. Di life wey I dey live naw, na bikos of di good tins wey God pikin do inside mi, bikos e love and die for mi.


God save una with en grace, bikos una get faith (as una don bilive Christ), nor bi with una own pawa, but na God give una.


So dat Christ go dey inside una heart thru faith and wen una don strong well-well inside God love,


I dey sure sey, di Pesin wey start dis good work for una life, go make am pafet until di day wen Christ go kom.


Den God peace wey pass wetin human being fit undastand, go guide una heart and mind, inside Christ.


Dem don tish yu God word since yu bi small pikin and yu don get salvashon to receive di wisdom wey dey kom thru Christ, wey yu trust.


bikos wi dey wait for di day wen God sey Christ, wey bi awa God Almighty and Savior, go kom.


So make any of una nor taya, but make una dey patient and bilive, so dat una go gain God promise.


na so too Christ die wons, as sakrifice to forgive pipol forever and naw, e go bring salvashon to doz wey dey wait for am.


So, make una always dey ready for akshon. Make una shine una eye and put hope for di grace wey Jesus Christ go bring.


Instead, make una dey happy as una dey sofa for Christ, so dat wen God go show una en glory, belle go sweet una.


Mi wey bi una fellow elder, wey si how Christ sofa and go share for God glory wey go soon kom, dey beg di eldas among una sey:


I pray make God pawa give us evritin wey wi nid, so dat wi go fit live di kind life wey E wont, as wi don know di trut about Jesus wey koll us with en glory and goodness.


My friends, wi bi God shidren naw and wi neva know as wi go bi wen Christ go kom back. But wi know sey wi go bi like am, bikos wi go si am just as E bi.


Dis leta na from Jude, Jesus Christ savant and James broda. To di pipol wey God don koll, wey Papa God love don wrap like klot for Jesus Christ body.


Naw, make all glory bi God own, bikos E nor let una fall and E go bring una kom en present with betta joy wey nor get fault.


E dey wosh and guide di pipol wey E choose, but E dey make wiked pipol shut up for di dark place wey dem dey, bikos nobody fit win war with en own pawa.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ