Si as yor favor great rish; di one wey Yu keep for doz wey dey fear Yu. Yu dey pour dem on pipol wey kom make Yu protet dem and Yu dey bless dem for evribody front.
For each side for di river, difren trees dey grow for der. Dia leaf nor go dry and dia fruit nor go fall, but dem go dey produce good food evry mont and dia leaf go dey cure doz wey dey sick, bikos di wota wey dey survive dem dey flow kom from di temple.”
“Den di king go tell di pipol wey dey en rite hand, ‘Make una kom, una wey my Papa don bless and make una inherit di kingdom wey God prepare for una before di world start.
yu go open dia eyes make dem for waka komot from darkness enter lite. Make dem komot from Satan hand, go meet God, so dat God go forgive dem dia sins and dem go follow di pipol wey God don make klean, bikos dem bilive am.’
And if wi bi God shidren, den wi go inherit God propaty. Yes, wi go follow Christ inherit God propaty, bikos if really wi sofa with am, wi go follow am enjoy.
Naw, di prize for raitiousness dey wait mi and na God wey dey judge rite go give mi dis prize for di day wen Christ go kom. Di prize nor bi for mi alone, but na for evribody wey dey wait for Christ to kom back.
Na dis make am bi middo-man for di new kovenant, so dat pipol wey e koll go fit receive di propaty wey go dey forever. E promise us dis propaty, wen e die to free us from di bad-bad tins wey wi don do wen di first kovenant still dey.
But know dirty or yeye tin go ever enter di town. Pesin wey dey do bad or dey lie, nor go ever enter der, but di pipol wey go enter, na only doz wey dem rite dia name for di Lamb Life Book.