Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Pita 1:17 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

17 Since una dey koll God wey dey judge evribody akordin to wetin e do, “Papa”, make una live una life with respet for am.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Pita 1:17
33 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Jakob ansa Fero, “I don stay for more dan one hundred and thirty years. And all di years wey I don spend for dis life nor many, but e nor dey eazy; di years wey I don stay, nor many rish di years wey my grand-grand papa dem stay.”


Awa Oga God! Yu know sey wi dey pass thru dis world like strenjas, just as awa grand-grand papa dem do. Awa days bi like shadow wey dey fade and wi nor fit run from deat.


Make una respet God as una dey take decision, bikos di Oga wey bi awa God nor dey like wayo, bribe or anyhow tins.”


E nor dey support rulers or rish pipol against poor pipol, bikos na-im kreate all of dem.


My God, make Yu hear my prayers! Make Yu listin to my kry for help! Make Yu dey look di tears from my eye. I bi like pesin wey travel kom stay with Yu, just as my grand-grand papa dem bi to Yu.


Den e go koll mi kon sey, ‘Yu bi my Papa, my God and di Rock wey dey save mi.’


Wise pipol get sense and dem dey avoid wahala; but foolish pipol dey waka enter trobol.


If yu always dey obey God, happiness go follow yu, but yu go distroy yor life if yu dey sturbon.


God sey, “I go take una back as my shidren kon give una betta land; di land wey fine pass for di whole world. Den una go koll mi, ‘Papa’ and una nor go turn from mi again.


Make una know sey, for dat time, I go make di nashons praiz mi well-well. All of dem go dey pray with my name kon woship mi with one spirit.


God Pikin and en angels go kom inside en Papa glory, den e go reward evribody akordin to dia work.


So dem kon send dia disciples, with some pipol wey dey support Herod, go meet Jesus sey, “Tisha, wi know sey yu dey tok trut well-well and yu dey tish wetin God wont. Yu nor dey favor anybody, bikos yu nor dey play wayo.


“So make una pray like dis: “ ‘Awa Papa wey dey for heaven, wi praiz yor name,


True-true, God break Israel pipol komot from di tree, bikos dem nor bilive am. But una dey where una dey, bikos una get faith. So, make una nor dey boast, instead, make una dey fear wetin God fit do.


Make God awa Papa and Oga God Jesus Christ give una grace and peace.


So, wi dey always get mind and wi know sey, as long as wi dey alive for dis eart, wi nor dey where God dey,


So, as God don promise us all dis tins, make wi wosh awasef komot from evritin wey go fit make awa body or awa soul dirty, so dat wi go dey holy as wi dey respet God.


Naw, make una si wetin dis vexnashon wey God plan don do for una: Si how una work for God bi naw; si how una won show sey una hand klean; si as una dey vex bikos of di bad tin wey happen; si how una dey sopraiz; si as una dey won si and worry about us; si how una ready to ponish anybody wey do bad! For evritin, una don show sey una hand klean for dis matter.


But doz wey tink sey dem bi oga, (wetin dem bi, nor mean anytin to mi; bikos God nor dey support bad tin); dem wey bi leaders for di church nor add anytin to my message.


I pray make God, awa Oga God Jesus Christ Papa wey get glory, give una spiritual wisdom and revelashon, wey go make una know am well-well.


Bikos of dis, I dey knee down for awa Papa front,


And una wey bi masta, make una dey trit una savant well. Make una nor make dem fear, bikos both yu and dem get di same masta for heaven and E nor dey favor pesin anyhow.


Bikos di Oga una God na God of all gods and Oga of all ogas. Na en bi di great Oga God, di God wey dey do wonders, God wey nor dey do wayo and nobody fit bribe am.


So, my friends wey I love; pipol wey dey always obey mi, (nor bi only wen I dey with una, but una dey obey well-well, even wen I nor dey with una). Make una kontinue to do God work with all una heart, so dat una salvashon go full well-well,


Pesin wey do bad, God go pay am back for wetin e do, bikos God dey judge evribody akordin to wetin dem do, since E nor dey support anybody anyhow.


Since wi don receive di kingdom wey dem nor fit skata, make wi tank and woship God with respet and fear. Make wi gi-am di kind woship wey go make belle sweet am.


Even doh God promise us rest, e good make wi dey kareful, so dat some among us nor go miss di promise.


My friends, I dey beg una, since una bi strenjas for dis world, make una nor follow di tins wey pipol like to do, bikos dem dey distroy pesin soul.


For una heart, make una make Christ una Oga God and make una ready to ansa anybody wey ask una about di hope wey una get.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ