16 bikos God word sey, “Make una dey holy, bikos I dey holy.”
One fine road go dey der and dem go koll am, “Holiness Road.” No sina go travel pass dat road and foolish pipol nor go fit deceive doz wey dey waka pass der.
I bi di Oga una God and una go make unasef pure kon dey holy, bikos I dey holy. Una must nor dirty unasef.
Na mi bi God wey take una komot from Egypt, so dat I go bi una God and una go dey holy, bikos I dey holy.
“Make yu tell Israel pipol sey, ‘Una must dey holy, bikos mi wey bi Oga una God, dey holy.
“ ‘Make una keep unasef holy, bikos na mi bi di Oga una God.
Two pipol go fit waka togeda, if dem nor gri?