Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




1 Pita 1:11 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

11 Dem one know di time and di pesin wey God Spirit dey tok about. God don tok before about di sofa wey E sey Christ must sofa and di glory wey e go get.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




1 Pita 1:11
29 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

I go make yu hate woman and yor pikin go still hate pikin wey woman born. Pikin wey woman born go mash yor head and yu go bite dia leg.”


Di pawa rod nor go komot from Judah and di pawa to take rule, go always dey en leg, until e go rish di pesin wey really get am and evribody go obey yu.


God tell mi, “My savant, I get big work for yu; yu nor go only make Israel pipol wey survive, great again, but I go still make yu di lite for di nashons, so dat all di world go dey save.”


For di time wey dis kings go dey rule, God wey dey heaven go raiz one kind kingdom wey nor go ever end. Dem nor go fit distroy di kingdom and anoda pesin nor go rule am. E go distroy and skata all di oda kingdoms. But dis kingdom go stand forever.


God wey dey mighty sey, “Swod! Make yu go attack and kill di shepad wey dey work for mi, den all di sheep go skata. I go attack my pipol


Den God go bi king for all di eart; evribody go woship and know am as God.


Man Pikin go die as dem rite about am, but curse dey di pesin head wey go sell am! E for betta sey dem nor born di pesin at-all.”


Den Jesus tell dem, “Na di word wey I tell una wen I still dey with una bi dis, evritin wey dem rite about mi for Moses Law, di profets book and Psalms, must happen.”


Profet Isaya tok dis tins, bikos e si how God honor and tok about Christ.


Wen dem rish Mysia, dem kon try to enter inside Bitynia, but Jesus Christ Spirit nor allow dem enter,


But una nor dey obey sin, instead, na as di Spirit sey make una live, na so una dey live.


Since wi bi God shidren, E put en Holy Spirit inside us and naim make us dey fit koll am, “Abba! Fada!”


bikos know profesy don ever kom out from human being mind. Instead, na di Holy Spirit dey kontrol di pipol wey dey tok God word.


So, I kon bow make I for woship di angel, but e sey, “Nor do dis tin! I bi savant and broda like yu wey whole di trut about Jesus well. Make yu woship only God, bikos na di profesy spirit bi di true word about Christ.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ